I now live in a convent... what is hmmm? hen? you think i'm not holy enough? or i like boys pass?... no talk like that jo... i am now living in a convent... simple...
okay as a boarder! lol
for economic and aesthetic reasons, tyger has taken up board in this beautiful convent that runs a foyer for young ladies...
leave story.. them go look your face well.. say you no get devil spirit or look, no come spoil the daughters of mary wey dey inside...
anyway, to all you player haters... dem look my face... dem like am... dey give me room for 500 dollars a month! breakfast thrown in ... cheapest shit in this side of the world...lol
but.. you know as my mind dey work... i look all the sisters (dem no be like all those sisters we dey get for secondary school wey dey bitter and wicked o) dem all dey serene, and sweet... all atleast 60 years old ... and i dey think .... these people no dey do! chei! at all at all! chei!married to Jesus!
i know no o...
i ask one of them i say Sister Eliza, how long you being married to Jesus? she say 41 years my daughter!! yayyyyyyyyyyyyyyyyyyyy, mo gbe... that place don close...
i no be like all of you na devil pikins, wey go dey talk say them nuns they sneak go 'do'...
you suppose see these people... you go know say 'do' no dey their body... wahala!... lol..
i still dey think am o...
if you love Jesus reach that kind put up your hand...
yeye girls and boys!
Checking
1 year ago